Powered by Blogger.

Blog Archive

Popular Posts

Sunday, 29 June 2014

Joke Of The Day:- The Oyinbo Man Palava (Don’t Try This)

| | 0 comments

joke Joke Of The Day: The Oyinbo Man Palava (Dont Try This)


E get one particular restaurant wey I dey chop 4 G.R.A. E get one oyinbo wey dey always come chop there too…


Anytime dis oyinbo chop finish, he go shout ”Hey”, so I wonder wetin dey make am shout.


I decided to chop wetin d oyinbo dey always chop so maybe me sef go shout too. When I reach d restaurant yesterday evening, I order wetin d man dey chop.


Dem tell me say na chicken & red wine, so i chop am, but i no shout, I collect extra plate, but i no still shout. I say dis oyinbo na mumu o, why e dey always shout like dat now?


Na then i just vex ask 4 my bill. The waiter tell me say one plate of chicken & red wine na N75,000 then d extra plate too na another N75,000. Na then I shout hey! heyy!! heyyy!!! ……!!!! heyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyy… ……..


I still dey shout till now. Happy Sunday you all.


The post Joke Of The Day:- The Oyinbo Man Palava (Don’t Try This) appeared first on Naijaloaded | Nigeria No. 1 Online Portal.






from Naijaloaded | Nigeria No. 1 Online Portal http://ift.tt/1q5oi9f

via IFTTT

iReportersTv Blogspot Template © Copyright 2014 - All Rights Reserved

0 comments:

Post a Comment

Twitter Facebook Dribbble Tumblr Last FM Flickr Behance